‘Na complete breakdown of my reputation’ – Alison-Madueke mention who dey behind her trial for UK

Read am in 5 mins Former Nigerian minister of petroleum resources Diezani Alison-Madueke say di corruption accusations wey she face break her reputation and integrity. Diezani say some cabals dey behind wetin happun to her and na sake of say she be di first female to hold high positions for di oil sector. For di…

Read am in 5 mins

Former Nigerian minister of petroleum resources Diezani Alison-Madueke say di corruption accusations wey she face break her reputation and integrity.

Diezani say some cabals dey behind wetin happun to her and na sake of say she be di first female to hold high positions for di oil sector.

For di first time afta her court case for di UK, she tok to di BBC on di kain accusations wey dem sama her and di pipo wey dey behind am.

Diezani Alison-Madueke na Nigerian politician wey become di first female president of OPEC and also di first female of Nigeria oil ministry.

Court sama Diezani wit five count charges wey surround accepting bribes and charge of conspiracy to commit bribery.

But di court later find her guilty afta di trial for London Southwark Crown Court.

Na di UK National Crime Agency (NCA), in collaboration wit Nigerian govment and oda witnesses bin chook eye for dis matter for court, but she dey cleared of all di charges.

Diezani say during di case wey run for about 13 years really affect her and no matter how she try handle am, she still no get di kain freedom wey she get bifor.

“Wen dem take your freedom away from you, no matter how you wan handle am, e get impact on you psychologically.”

Pesin wey dem see as one of Africa most prominent political figures, Diezani say di accusations “dey completely damaging from di beginning sake of say I be president of Opec.”

She say some pipo bin target her sake of say she hold position as female president of Opec, wey be Organization of Petroleum Exporting Countries.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

About the Author

Opeyemi Precious

Precious Opeyemi is an independent media entrepreneur, journalist, and the founder of Scoop Lounge. Driven by a commitment to credible, balanced, and high-impact journalism, she established the platform to deliver rapid-response news summaries across multiple global sectors. Read full

Search the Archives

Access over the years of investigative journalism and breaking reports